MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 10 November 2015

ASA DON JOIN DIS GIRLS DEY DO DIS TINS TOO?

For sometime now,di reigning tin for naija female celebritis na to show dia ikebe,show some part of dia bobbi,show dia lap,wear bumshot and even wear naked dress.
Dem don get dat mind say na all dis kain tin naim go make u dey reign and belong.
Di pipo wey dey dis catigori na di goddess of x,Maheeda,Cynthia Morgan,Tiwa Savage,Seyi Shay and plenti odas.
E work for some of dem,why e don bring plenti insult to some.
One babe wey no join bifor but e be like say she don dey join dem smallsmall na Asa.
Wondafu miuzishan,strong miuzishan,singa to bad but dat spirit wey dey tell dem pull clothes troway,pull clothes troway don dey enta her bodi too.
Na babe wey bin dey cova evrievri bifor but of resent she don dey show her lap,her bobbi.
Make i nor yarn too much check out more Asa foto for bottom hia:



No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...