MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 11 November 2015

NA BIG MISTAKE WE MAKE TO ALLOW GOODLUCK JONATHAN CONTEST 2015 ELECTIONS-PDP

To make enimi nor hard na to get real frend bi di koko.
Real frend go dey wit u,even if to yarn lies go protect di frendship,dem readi to yarn di lie.
But e gud to talk truth sometime sha.
Right now i nor know weda forma presido,Goodluck Azikiwe Jona,go stil see di ogakpatakpata of Africa Indipendent telivishon(AIT),Chief Raymond Dokpesi as him gud frend or not.
If dem say make dem call name of pipo wey gain for oga Jona regime,Dokpesi na nomba one.
Big name for PDP,Raymond Dokpesi and Chairman,National Planning Committee of di join bodi meeting wey PDP dey plan to take re-oganize dia parti,yarn say PDP don do plenti mistake welwell.
He use di opotuniti beg all PDP membas and folowas make dem no vex for all di mistake wey dem make.
He even yarn say na heavi error to allow Goodluck contest for 2015 bicos wen Yar'adua die,dem sopose allow anoda of him area man replace am but some kain pipo wey dia head no koret naim pick Jonathan to kontiniu.
Well,i dey wait wetin Oga Jona go yarn for dis kain mata as Dokpesi don call am big mistake.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...