MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 14 November 2015

OMO,SEE HISTORY AS R.KELLY DON FEATURE WIZKID FOR HIM NEW ALBUM,"BUFFET"

Like play,like play dis one don pass moin moin talk o.
Wizkid of today nor be di smallie of yestaday again as di boy levels and GP dey rise like tempraychor for inside car wey hin coolant don finish.
Since obodo oyibo rappa,Drake remix Ojuelegba wit Tinnie Tempah,na up above di sky tins just dey appun for Wizzy side.
Many intanashona miuzishan just dey praise di bobo and him track,Ojuelegba.
Alicia Keys and her hosband,Swizzbeatz join dia mouth for di praise too.
As if dat one na just di bigining of God favour for Wizkid life be dat,di biggest grace don fall on topam as R.Kelly don fichoram for him new album wey dem call "buffet".
Dis kain tin neva appun for any home base Naija artiste bifor say Grammy award winna and grade A miuzishan from obodo oyibo fichor u for him song.
Di one wey evribodi know na di Naija miuzishan go pay beta moni just to put di voice of dis pipo for dia song.
Abi u don forget R Kelly now now?
In case u don forget,R Kelly na one miuzishan wey di hole world dey die for him miuzik.
From cape to Cairo,from lokoja to Italy,from yaounde to livapool,from ethiopia to Canada,dem dey respect R Kelly to pieces.
Di guy don put Wizzy for di jam wey him call,"I just want to thank you" and if i hia say na babe dem dey thank instead of baba God for di song,I go para for R.kelly like say he dey owe me 50billion dollars.
Oda miuzishans wey dey dis album na Ty dollar $ign,jhene Aiko,Juicy J,Jeremih,Lil Wayne and Tinashe.
Omo wen God put hand for yor mata,e nor pass like dis.
I pray make God notice yor mata dis morning bifor di next tori.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...