MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 2 January 2016

NAMES OF ARTISTE WEY DIA CAREER RUN DOWN AFTA QUARREL WIT DON JAZZY


Tori pipo stil dey smart from di kasala wey boss out bitwin Olamide and Don Jazzy for di Headies awards.
Di tori sef don tire pesin but make I quikquik giv u di names of pipo wey dia karia nor kon too blow again afta dem get kwanta wit Don Jazzy.

1. Ikechukwu
Ikechukwu na nomba 1 for dis list.
Di bobo miuzik bin dey make sense to naija pipo espeshali dat jam 'critical' ft D'Banj.
Afta Don Jazzy decide not to reliz him album for 2011 bicos of dia misundastanding,di bobo karia dey strogle til today.

2. Duncan Mighty
Port harcourt first son Duncan Mighty,see di promise land but like Moses for Bible,di bobo nor fit enta.
Don Jazzy don make up een mind to sign Duncan Mighty as produca for Mohits dat year but bicos say Duncan Mighty announce for evriwia say dem don sign nam,na once Don Baba J cancel di kontract and since den di bobo miuzik dey strogle like westbrom.

3. Terry G
Inshot,na di same rope tie Duncan Mighty and Terry G.
Na small tin remain,he for join Mohits as produca bicos een own appun bifor Duncan Mighty.
E be like say Duncan read some Terry G textbook as dem two announce dia kontract bifor dem getam.

4. D'banj
Di biggest fish wey di tin affect pass na di Koko masta imsef,D'banj.
Di last song wey Don Jazzy produce foram,Oliver Twist,naim be di last one wey pipo all ova di world die for.dat song naim make Kanye West sign him and Don Jazzy for een record kompini 'Good Miuzik' di next year.
As D'banj and Don Jazzy quarel,di bobo don enta oda bizness and e don dey sell Koko garri now.
Even one of my frend say dem see D'banj for Ghana dey sell gala.

5. Wande coal
Til today,Wande Coal neva fit sing any song wey bit di ones wey dey him first album "From mushin to Mohits".
Na Don Jazzy naim hando evri evri for dat album wen Wande stil dey Mohits but dem dey cane dia own line for ova two years now afta dia quarel.
One of di best miuzishan wey Naija don get for di past ten years.
Wande Coal nor dey do too bad but im levels don drop welwell kompia to dat time wen he dey Mohits.

To konclude,if u be Olamide frend or fan,start yor fasting and prayers now make anytin nor appun to him karia afta he troway plenti curse give Don Jazzy yestaday.
Dia is notin wey God nor fit do and protect.
Oya start yor prayers today for badoo.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...