MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 18 January 2016

DENRELE 'DI KING OF AKPOLA SHOES', DON FALL AND INJURE HIM EYE BICOS OF PEPPER SOUP AS DI BOBO LOOSE SOME BLOOD

Call am di madman of naija entatayment,u nor dey wrong.
Crazy mc,Denrele sopose fall and faint wit him akpola for one new home vidio 'Pepper Soup' but wetin later appun for set shock evribodi.
Bifor dem even say make dem roll di camera,di bobo just fall yakata by mistake and hit een eye for one sharp tin for floor.
Di eye tear and di bobo gragra vanish and he kon gentle by force.
Di plenti blood wey comot for kona of een eye nor be small as fear catch di production team.
Dem nearli kanso di shoot but Denrele say no way,di show must kontiniu.
Dat Denrele boy,
Na strong bobo be dat.
Make I borrow one inglish from Sir Shina Peters..,I wish Denrele 'Soonest Recovery'.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...