MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 7 January 2016

GIANT MAN: DI TALLEST MAN FOR NIGERIA

My frend,use dis yor height take wack millions.
You cant tall like dis and Kobe Bryant and Lebron James go dey use basketball dey chop millions live u.
Kobe Bryant don retire last year so make sure u take een position next season.
Yao Ming of China nor tall pass u and he use een height take kolobi millions for basketball wit Houston Rockets for yankee.
Di guy nor dey sweat imsef too much as he go just stand for near di net dey hep Houston put di ball for basket.
Anyway,I just say make I advice dis man wey rumors say naim be di tallest man for naija.
Him name na Hafiz a.k.a Agoro and Fuse tv radio presenta,Vina share di pishor wey she take wit Hafiz.
Di guy dey stay Akoka area for Lagos di same area wia Univasiti of Lagos dey.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...