MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 21 January 2016

FELA PIKIN DON YARN SAY HANDCUFF TOO SMALL,NEXT TIME CARRY METUH GO COURT WIT LEG CHAIN

Fela pikin,Seun stil kontiniu di yabis for wia een papa stop as he don yarn one strong one konsigning Olisa Metuh,di forma talku talku pesin to PDP.
Metuh don enta Federa Govment wahala as dem trace N400million from di $2.1billipn of di wipons money wey Sambo Dasuki share among dem dem.


As I dey yarn wit u,Olisa Metuh dey jail and na from dia dem dey carry am go court.
Many PDP pipo don dey para for govment say why dem dey handcuff am come court evritime.
Now one pesin don vex as he say handcuff too small make dem carry Metuh go court next time wit leg chain.
Seun Kuti naim yarnam and he say why naija pipo go take di mata like one big ting.
Seun say dis na di same naija wey dem dey burn pipo witout trial sake of say dem call dem winsh.
Dem dey even burn crimina bicos of N20 and nobodi dey yarn and now dem handcuff pesin wey dem say he cramp N400million and e kon be one big news as pipo just dey talk nonsense.
Seun Kuti say next time wey dem dey carry am go court,make dem chain Metuh leg join.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...