MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 7 January 2016

FINALLY P-SQUARE DON SIGN ANODA ARTISTE 4 YEARS AFTA DEM KWANTA AND DUMP MAY D


I hope say dis new artiste wey PSquare don sign for dis 2016 afta 4 years,nor go also turn di rat and cat fight wey dem fight wit dia last artiste,Mr May D?
Dem don finalli diside to sign anoda miuzishan to dia rekord label and he name na Muno.
Na Paul Okoye naim anounce sam for intanet.
He say dis na new year and he swit dem for belle to present dia new singa and di bobo voice naim swit pass foreva and eva.
Paul say nor be joke o!say di bobo voice swit pass bird own.
We don hia.
Time go tell weda he sabi sing pass my parrot for wey win Grammy award last year.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...