MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 4 January 2016

MR ROMANTIC: SEE PLENTi HAILINGS FOR FACEBOOK FOR DI ALHAJI WEY HEP HIM WIFE CARRY HER HANGBAG

Oyibo pipo make una kon read dis tori o.
Nor be only una sabi respect una wife,we don len.
Shuo!dem nor dey tell pesin wetin dem dey use maggi na.
Na so di ting go.

All di paloma and telemundo wey we dey watch nor be for notin as we don use am go far like una for love mata.
See di plenti hailings wey
 one Alhaji get as him tori come out for Facebook.
Di Alhaji show di hole world say him na di real mista lovaman as he hep him wife carry her handbag.
He say,wetin be handbag wey him nor fit carry wen he be say di wife dey carry and back dia pikin.
Di Alhaji troway shameness put for one kona and hang di bag for sholda wella.
Time nor dey.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...