MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 16 January 2016

PAUL OKOYE OF PSQUARE DON TELL MUNO SAY NOR BE TO GET GOOD VOICE,HE MUST DO WEIGHTLIFTING AND GET SIX PACKS MAKE GIRLS FOR LIKE AM

Notin we nor go hear sha.
Rudeboypsquare wey he real name na Paul Okoye sign one new artiste some days ago to een own pasona rekord label,Rudeboy Records and he don dey give di boy some kain advice wey fit cut di bobo liver.
But Fela nor get six packs na.
Rick Ross and Dj Khalifa nor get odnari one pack but gehs gbadu dem pass who get twelve packs.
Anyway,Paul na Muno new oga,so he must do wetin he want.
Now he don carry Muno go gim and advise am say nor be to get gud voice,he must dey gim make een belle dry,make muscle fulam and turn to six packs bicos na wetin gehs dey like be dat akordin to Paul.
 Paul also yarn say afta di drilling, Muno nearli cry and dis na just di bigining.
Double wahala.
To be star nor easy at all.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...