MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 17 January 2016

KASALA DON BUST AS SOMEBODI DON RELEASE DI SIKRIT OF HOW ICE PRINCE GIRLFRIEND TAKE DEY CHEAT ON AM WIT AKINBODE FROM ABUJA

Di love nwantiti wey naija rapper Ice Prince and een Ghana geh frend,Maima take dey pepper our eyes don dey jam rock wit style as sombodi don post pikchors of how one Akinbode from Abuja take go flex di babe for Europe.
Akordin to di tori wey dey rish our backyard,na di Abuja bobo even pay for her chest tattoo and di bobo also resentli carry Maima folow bodi and sponsor her joliment to France and London.
Now sombodi don reliz di pishors of Akinbode and Maima wey dem take for di same place.
Chai! pipo wicked o!
Di fine shenkez Maima some fiu days ago,post on top Instagram her love for Ice Prince and how she fit take die for di rapper mata.



See di Akinbode and Maima evidence for bottom hia:


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...