MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 11 January 2016

DAVIDO DON DROP GHANA ARTISTE FROM HKN GANG AND HE DON ALREADI SIGN ANODA ONE

DAVIDO AND DEEKAY
Small pikin yarns nor dey eva finish for dis boys dem mouth as Davido don yarn some kain tins dis morning for twita about pipo wey dey him HKN group.
For one of di twita post,Davido say..

!! @danagog @B_RedHKN @SINARAMBO HKN …. If I nor mention ur name naim be say u nor dey my group and I nor dey responsible for ur life.. U KNOW URSELF
— Davido (@iam_Davido) January 10.

He fail to mention one pesin name for di group and na Ghana miuzishan,Deekay wey di bobo sign for 2013.

Na wa for dis pipo. Na so lida take dey yarn?
If u be lida for 23 years,naim be say God bless u be dat but u must Len how to follow yor workas yarn.
On top twita,Davido also mention Dj Olu as di group dj and Shizzi as dia produca.
Davido say na Shizzi make dem be wetin dem be today.
He also yarn say he don readi to let di world know about di new artiste wey he sign and if di bobo nor win dat award wey Reekado Banks win for Headies dis year,een go skata evriwia.
Davido,as u dey skata,pray make sojas nor dey there dat day.
Dem sabi tie pesin flog welwell.
Dem don flog my frend ear bifor.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...