MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 30 December 2015

Di MOMODU AND Di ADELEKE FAMILY DON SKATA INTERNET FOR GROUND BICOS OF DAVIDO AND BABY MAMA,SOPHIE FIGHT

Wot a way to end di year for tori pipo.
Tori pipo nor get to skata dia head just to find fresh tori as plenti to write don land.
David Adeleke aka Davido and him baby mama,Sophia Momodu don sign war on top di tin wey join dem togeda,dia pikin,Imade.
7 months old Imade,dey wit Davido family right now and dem say dem seize am from di mama bicos she nor dey take kia of di baby well.
Dem say dem run test for di pikin and find out say she dey suck ganja from di mama breast since bicos na so so ganja di mama dey smoke but di babe don deny say Davido lie for her head.
Di Adelekes say right now di pikin dey sick since all di igbo dey go strait to di mama breast as a result dem get fly di pikin go tritam.
But di Momodus wey ovation magazine owna,Dele Momodu be dia lida,say Davido and him family kidnap di baby and dem dey travel wit di baby and di mama nor know about am.
As we dey yarn like dis,imigration pipo for airport don seize di Adelekes passport make dem nor fit bend live di kontri.
Dele Momodu wey be Sophia uncle,get koneshon and Davido papa get money.
'Money power'and 'koneshon' don jam demsef.
Who go win.
Bifor I say make I write dis tori complit,more drama don come out as Davido and Sophia don exchange words tire for twita.
If nite nor quik reach,I go bring una all di tori.
Dis one na season 1 of dis drama,make I kross road go buy akara first.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...