MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 4 December 2015

GOODLUCK JONATHAN GIVE ME ORDER MAKE I SHARE 10BILLION NAIRA GIVE PDP OGA THEM-DASUKI

Forma nashona sikioriti advisa,Sambo Dasuki,don dey sing some kain miuzik for wia State Sikioriti Service,SSS,kipam.
Dem arrestam some weeks ago sake of say he spend di 2.2billion dollars wey dem givam take buy wipons anyhow.
To get money hard,na to spendam naim simple.
For dis past few days,tori pipo don dey repot say Dasuki don dey call names of pipo wey dem chop di money togeda.
We don see how dem take arrest AIT owna,Chief Raymond Dokpesi.
Oda pipo wey we don hia dia name for dis mata na,forma Rivers state gofnor,Peter Odili,Bode George and odas.
Now di baba of all sikrit on top di mata,naim we don hia so as tori pipo,Sahara reporters,don report say,Dasuki don talk say,forma presido,Goodluck Jonathan,givam order make him share N10billion give PDP big names wey enta one of di party joinbodi meeting.
See Sahara reporters evidence for twita for bottom hia:


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...