MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 9 December 2015

ADELE ''HELLO'' NOR BIG REACH WIZKID SONG "OJUELEGBA" FOR 2015 AKORDIN TO AMERICA MAGAZINE"THE FADER"

If you stil dey handle Wizkid mata wit kid glove,u dey on a long ting as Yankee magazin,The Fader,don pick di bobo song as di nomba 12 bigest song for di world for 2015.
Di New York base magazin,The Fader,cool down select di songs wey di world feel pass for 2015 and Naija own Wizkid song Ojuelegba,stand gidigba for nomba 12.
Di Fader yarn say,apart from say Drake and Skepta remix Ojuelegba wey kon make di song popular for America and di world,dem say,Ojuelegba on e own,tight die.
Dem say di inspiration wey di song carry nor be here.
Di Fader also yarn say,di kain grace wey follow di song and di kain wicked beat wey follow am,too dey strong not to reign,even if Drake and Skepta no remixam.
Adele Hello, wey don brake some kain record dis year,dey for nomba 26 why di nomba one song akordin to di Fader,na "Where Are U Now" by Skrillex and Diplo featuring Justin Bieber.
Congratulabia Wizzy as you kontiniu to dey rob shoulda wit ogbonge intanashona miuzishans.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...