MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 3 December 2015

WONDAMENT!!! SEE Di 11 YEARS OLD BOY WEY BOKO HARAM SEND TO GO COMMIT SUICIDE BOMBING

To send 11 years old boy make he tie bomb for bodi so dat he go kill imsef and oda pipo,all in di name of fighting for our right,na veri wicked tin.
Even sef,make somebodi take di life of anoda human being,na veri veri bad tin.
Imagine as Boko Haram send 11 year old Usman Modu Tella to go comit suicide bombing.
Wot a wicked world!
Tank God for di vigilante wey dey provide sikioriti for di camp of pipo wey nor get haus to stay again for Borno state afta Boko Haram attack dem.
Na di vigilante pipo kon catch di boy wey also confess anoda boy wit di same mission for inside di camp.
Akordin to di tori wey di acting direktor Army public relations orfisa,Colonel Sani Kukasheka Usman give tori pipo,he say di smallie dey nomba 82 for di list of di 100 most wanted terrorist.
Di boy na one of di four shidren wey Boko Haram don train for suicide bombing as di oda three don alreadi carry out dia mission.
God save yor shidren.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...