MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 6 December 2015

SINGA TURN WRITA,ETCETERA DON YARN SAY,ASA JOIN UP WIT NAETO C AND KOREDE BELLO DO Di WORST COLLABOS

If you dey look for tori pesin wey get bad mouth pass agbero,dat pesin na 'Etcetera'.
Di bobo mouth bad finish as e don yarn say he shame for grade A miuzishan,Asa sake of say she folow join do collabo wit Korede Bello and rappa Naeto C.
Etcetera say na di worst collabo dem for di world be dat.
He say dat Naeto C song 'share my blessings' wey Asa joinam sing,na robish song.
Etcetera yarn say weda Asa nor dey listin to di tin wey dis guys don sing bifor he dey join dem for dia robish?
He also yarn say di one wey Korede Bello fichor Asa'Somebodi Great' fit make kam vomit sef.
He na Ty mix and Don Jazzy he blame since na dem produce di songs bicos dia ear sopose tell dem di yeye tin wey dis bois dey sing bifor dem dey involve Asa for di mata.
Well,di guy don yarn he don yarn ova to you to gree weda he dey yarn trut or not.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...