MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 7 December 2015

PHYNO DON DEY MAD?FANS DON BLASTAM FOR SAYING MAKE PIPO DONATE FOOD FOR DOGS INSTEAD OF HUMAN BEING

Strong local Ibo rappa,Phyno don put imsef up for fans blasting as he go post for Instagram say make pipo contribute food for dogs wey dey hungri for street.
Nobodi know who sendam mesage but di tin be say many pipo dey para for dat kain yarns wen e be say modaless babies need wack like mad.
Even pipo wey Boko Haram turn to homeless pipo wit no food to eat,dey one kona.
Wot about orphans? (pipo wey nor get papa and mama again).
Pipo many wey need di food pass dogs.
Make Phyno yarn somtin else instead of am to dey beg crowd to donate give one charity joinbodi wey dey feed hungri dogs.
I nor soprise for Phyno bicos di same Phyno say make naija pipo say 'prayer for Paris' afta terrorist bomb dem and kill ova hundred pipo.
Fans stil blastam say he live pipo wey Boko Haram don cage wit dia bombing dey talk about anoda man kontri.
Check wetin di fans telam for di dog food mata bottom hia:


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...