MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 16 December 2015

OONI OF IFE DON GET ENUFF CURSE FROM PIPO BICOS HE GO CHURCH GO THANK BABA GOD

Na wa for dis kontri sef.
Di kain pipo wey make up some kain kontri dey make pesin dey wonda.
Anytin wey u do,pipo must yarn.
E be like say pipo nor send di yarns wey we grow up come meet say,"di fear of God is di bigining of wisdom".
Imagine,Ooni of ife,carry waka enta church go tank di Agbadagbururu,di Rock of Ages,Elshaddai,Ancient of days,di Alpha and Omega,di King of King,Baba God imsef,pipo stil talk.
Some pipo even dey yarn say,wetin he find go church.
King wey gree say anoda King dey wey big pass all King,u sopose clap for dat kain king.
One wey call imsef Teekay Arabambi Akin,talk say,"di Queen of England,wey come from wia dem from bring church,nor dey go church go kneel down for church or kneel down for di god or Jesus,but Ooni of ife stool,wey be say na respected sometin from our ancestors,dey go church go bow down.
He say dis kain tin na insult to our culture and to our pipo bicos e dey veri annoying.
I nor undastand wetin dey appun for dis kontri.
Anyway,make I live di mata for matayas.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...