MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 2 December 2015

YAGA!!! WIZKID DON DEY MATURE O!SEE WETIN HE REPLY ONE FAN WEY CALL AM 'MUMU' FOR TWITA

If na bifor,dis bobo wey he name na @vjkunzee for twita,for don resiv one beta curse from Wizkid afta he call Wizzy mumu on top say,for di #Longthroat pepsi advert,Wizzy use Ferari motto of one million dollars,take exchange ordinari bottle of pepsi wey dem dey sell N100.
Infact di wholesale price for pepsi na like N80.


Altho e be like say na joke di bobo dey joke but if na Wizkid of dose days,he no go care weda na joke.
He for samaram one wicked reply and di bobo sef go filam.
He show say Wizkid don dey escape comot from kid dey enta man mode as he don dey control him tempa.
Nice one Wizzy,kip it up.
Na so e soppose be.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...