MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 17 December 2015

DANIEL WILSON DON DECLARE MAJEK FASHEK AS DI GREATEST MIUZISHAN AFTA FELA AND REX LAWSON

Di truth bita like bitaleaf but one man don yarnam di way wey he siam.
Reggae star and Mr ragamuffin,Daniel Wilson,don yarn say Majek Fashek,na di best miuzishan for dia generation.
He say,afta Fela and Rex Lawson,nobodi large rish Majek.
Daniel Wilson yarn dis one on top Facebook afta he meet wit Majek Fashek.
Although he say God bless him generation as di best wey Naija don produce wit beta talents like Ras Kimono,Shina Peters,Bright Chimezie,Mike Okri,Oritz Williki,Victor Essiet,imsef but Majek nor get rival among all of dem.
He say dem tight,dem gud but wetin Majek di rainmaker achiv even tho say he nor go one beta skul and also lack expirience,pass all wetin dem achiv by far.
He say di rainmaker nor get rival wit di kain raw talent wey een get.
You concur?

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...