MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 15 December 2015

NO MORE QUAREL AS DAVIDO AND WIZKID PERFORMANCE PICTURES TOGEDA DON SKATA INTANET

One tin wit me,i nor dey like to see pipo dey kip enimiti wit demsef.
Dis one kon make belle swit me as two shidren wey dia money plenti welwell,Davido and Wizkid,don show say di lafta wey frendship dey bring beta pass di bad belle wey enimiti dey spread.
Two of Naija biggest stars right now,Davido and Wizkid,bin nor dey see eyeball to eyeball as dem always dey use brain find diasef trouble for twita and Instagram.
But dem don use dia church mind settle di mata for sometime now.
As if dat one nor rish,Remi Martins,kon cement di settlement wit one ogbonge show wey two of dem for climb stage togeda and entatain di crowd last wikend.
See more pishors of two of dem for stage for bottom hia:




No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...