MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 20 December 2015

TREY SONGZ DON YAB BEN BRUCE FOR TWITA BUT NAIJA PIPO GIVAM DI YABIS BACK

If naija pipo won unite dem dey unite finish only say some kain times dia head dey touch.
E get one ting wey appun on top twita,naim i take know say naija pipo nor dey carry last.
If Ben Bruce nor get mind to sarv well bifor for senate,e go change mind by force bicos of di love wey Naija pipo showam.
Dis year Rhythm unplugged konsat don come and go but di yankee miuzishan wey dem bring come paform for di show,Trey Songz,bin won show imsef but naija pipo don putam for wia he belong.
Naija senator Ben Bruce play enta di show and like evri oda pesin,he take some foto wit some pipo including di one wey he snap wit Trey Songz.
Wen daybrake,naim Senator Bruce put di pishor of imsef and Trey Songz on top twita and kon tag di 'R and B' star.
Instead of di yankee boy to apriciate our senator,he kon say make our senator try improve on him smile.
Trust naija pipo,dem dasham di yabis back fast fast.
Shoe nor get size abi di bobo chop winch?
Read Ben Bruce,Trey Songz and fans yarns ontop twita konsigning dis mata for bottom hia:


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...