MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 10 December 2015

TUFIAKWA!!! SOUTH AFRICA 800 METRES WOMAN RUNNER,CASTER SEMENYA,DON MARRY ANODA WOMAN


Baba God,wia you dey?
just in case yor angels neva reportam to you,women don dey marry women and men don dey marry men o!
Baba God,i just say make i stil yarn you even tho i know say u don alreadi know.
Imagine,forma 800 mita champion from South Africa,Caster Semenya,don marry her long time geh frend,Violet Raseboya for di tradishona wedding wey dem do for Ga-Dikgale for di Capricorn area of Limpopo last wikend.
Semenya and Raseboya don engage demsef since May 2014.
Di 24 year old Semenya wey pipo dey feel say na man wit di way wey she look,naim win di women 800m Championship race for Berlin,Germany.
Imidiateli she winam,na quik quik dem do test foram for 2009 to know weda na man or na woman she be but di result of di test show say she be woman true true.
Di rizin why man and woman dey marry na to live hapili and born shidren but now wey two women,Semenya and Raseboya,don decide to marry make i look out for how many shidren dem go born.
See more of dia orishishi wedding pishors for bottom hia:




No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...