MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 19 December 2015

D'BANJ DON BEG NAIJA PIPO NOT TO PUSHAM TO MARRY DI WRONG PESIN

Evriday wen u go marry!? wen you go marry?!
Tori pipo and fans nor allow D'banj dey rest.
Wetin sef!shuo!
Na by force!
Now di koko masta don fireback dey beg evribodi make dem chilax for di mata,make dem no go allowram marry di rong malawi.
D'Banj say mariage na evalasting tin so diafor make pipo kpror for di mata.
He yarn all dis one for one get togeda and he promise say he go marry wen him don readi.
Rumor bin go round say he plan to marry bifor di year go end,
Di same rumor wey D'Banj don deny.
Di bobo talk say, 'so bicos een yarn say,he go soon marry,naim kon make pipo dey hepam hurry for di mata?
D'Banj say,thy shall not worri yorsef bicos him go marry wen di world don readi foram.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...