MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 15 December 2015

OBAMA DON APPOINT NAIJA MAN FOR ONE OGBONGE POSITION FOR AMERICA

President Barrack Obama of Amerika,don choose naija pesin,Adewale “Wally” Adeyemo,as him deputy national security adviser for international economic affairs.
Na beta news be dat but i dey fear small o bicos na almost di same position wey Sambo Dasuki get unda forma presido,Goodluck Jonathan be dat.
Why Dasuki own na National Sikioriti Advisa,Adewale own na Deputi National Sikioriti Advisa.
Presently,EFCC don arrest Dasuki bicos of $2.1bn wey sopose be money to buy wipons.
But Dasuki share di money among Naija politishans espeshalli PDP membas and i hope dat kain spirit nor go enta Obama man,Adewale Adeyemo.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...