MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 20 December 2015

BUCHI DON YARN SAY,"E GET ONE TIME WEY FIRE BURN EVRITIN FOR EEN HOUSE BUT E NO TOUCH HIM BIBLE''

Naija gospel reggae miuzishan don yarn tori pipo,Punch say,devil try een faith welwell to see weda he go stop to sarv God.
He say for 2014,fire burn one part of him haus and studio down for Ogba,Lagos.
Buchi say evritin burn down except one tin,him "Bible".
Di mma ma singa,say na di handiwork of God but wen dis kain tin appun,e go be like say make u vex blame God and tink about oda solushon but base on evritin,een faith and biliv in God nor shake.
He say een faith for God stil strong kakaraka.

He yarn say dat day wey di haus dey burn,he dey stage dey paform for Warri and na spid he take enta road back to Lagos to hando di ploblem wey di fire bring.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...