MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 2 December 2015

HALLELUYAH!!! SOUTH AFRICA DON OVATAKE NAIJA FOR CORRUPTION...OYA READ AM

Nigeria dey carry first for many yeye tins but make i nor menshon dem.
E get one tin wey naija for nor dey carry last but nomba one evritime and dat tin na koropshon.
But bifor South Africa fit ovatake us for koropshon for Africa akordin to Transparency International,naim be say beta dey come.
I be no won biliv but bicos say Transparency International na joinbodi wey dem know for di world to dey check many tins wey nor dey rite,naim make i biliv.
Bifor dem go rank kontris for dis kain mata,dem go fest do di survey and afta dem do am,na South Africa naim win di koropshon cup for Africa.
But sha o,Nigeria and Ghana akordin to Transparency International,na two kontris wey still koropt welwell as na small gap naim South Africa dey give dem.
Anyhow u see am sha,for us not to dey nomba one,show say hope dey.
Bicos bifor,we dey carry fest for di hole world for koropshon not to talk of Africa.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...