MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 20 December 2015

Di SUN NEWSPAPER DON RETURN DI N9 MILLION ''DASUKI VOICEMAIL MONEY" WEY DEM SHARE REACH DEM

Dasuki
Anoda new tori don buss out for di wipons money wey Sambo Dasuki cramp and take play kalokalo.
He cramp some money to imsef and share give some oda pipo and right now,tori paper,Di ''Sun Newspaper'' say dem don return 9m wey gofment take konpensate dem dat year wey dem close di paper down.
Akordin to di statement wey Mr. Eric Osagie di managing direktor sign,he say dem return di money bicos dis mata don dey tie wrappa.
He say forma presido,Goodluck Jonathan,give di Newspaper Association Of Nigeria(NPAN) N120m to conpensate diferen newspaper wey dem seize and dia share na di N9m.
He say dem bin won carry gofment go court dat time bicos dem seize dia papers but afta dem kolet dat money,naim dem kpror for di mata.
Akordin to di statement,di main tin wey make dem return di money na bicos dem find out say na di wipons money dem share rish dem dat time.
Dat wipons money wey Jona hand ova to National Sikioriti Advisa,Dasuki,don cause beta kasala bicos di money don enta voicemail.

Now Buhari regime dey try to fish out pipo wey join chop for di money.
If u dey read dis tori,return yor own kiakia bicos if Dasuki menshon yor name,u don enta EFCC wahala be dat.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...