MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 11 December 2015

BREAKING NEWS!!! TANZANIA MODEL DON DEY PREGNANT FOR DAVIDO?

Omo see gobe!
E be like say Davido don skor anoda goal o.
Dis time,e be like say na outside kontri di baby nomba 2 dey come from.
Tori wey dey rish our yard now now,be say,one model from Tanzania,Agnes Masogange,dey pregnant and e be like say she don use brain dey sing Davido name for di mata.
Davido even attend di babe birthday groove for novemba.
Dis baby wit big ikebe,put customize Davido HKN pendant for Instagram.
She kon write on topam say she miss Davido welwell.
Afta sometime,she kon display di result of pregnancy test wey dey positive for same Instagram.
Like dis,like dis base on wetin she don dey use style dey do for Instagram,plenti pipo don dey conclude alreadi say,e be like say Davido naim packam put.
Na so Sophie Momodu own take start wen her uncle,Dele Momodu di Ovation magazine owner,first break di news say her cousin don born baby geh for Davido.
Afta sometime, Davido naim kon even dey baff di pikin,dey take foto wit di pikin.
Dey giam breast sef and make many confession of how he love di pikin.
I go bring una more tori as e konsign dis Tanzania shenkez imidiateli e enta.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...