MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 4 December 2015

HOW MANY OF UNA KNOW SAY PASTOR ADEBOYE NA MATHEMATCIAN BIFOR?OYA SEE WHY FOR UNILORIN

Matimatiks,na my best subject,lol.
I nor know y many of my frends hate matimatiks.
But make I let u know somtin.
Di genera ovasia of di Redeemed Cristian Church of God,Pastor Adeboye,na sirios and strong matimatishian.
In case u nor know,he know maths so tay,he bicom lechora for univasiti of Ilorin.
See di pishor wey baba take wit him fellow lechoras for 1979/1980 tiching calenda.na baba sidon first from left for bottom hia:

Unlike most of my frends wey dey see maths run,Adeboye dey see maths hapi.
No wonda he nor di see di word of God run.
Matimatiks haters,make una try buy maths set plus ruler and if u see di man of God next time,as he dey pray for u,rememba to telam make he tich u some maths too.
God bless u today.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...