MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 13 December 2015

O BOY! SEE WETIN ONE MANCHESTER UNITED FAN DO TO HIM PLASMA TV AFTA DEM LOOSE TO BOURNEMOUTH

Who nor go nor know.
Na sport betting dey reign for di town now o.
Di spirit of 'if u can't beat dem,join dem', don enta crowd bodi for dis betting mata.
Weda na betting skills fail dis guy or na real Manchester United fan wey dey vex say dem loose,I nor fit tell o.
Man U loose 2-1 to bournemouth yestaday for dia primia lig match.
Imidiateli referee blow wisso,..piorororooro,!..say match don end,naim di bobo smash him TV wit grade A annoyance.
I pray say make di ownas of Man U replace di plasma foram if not,naim pocket go sofa ram nor be me.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...