MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 9 December 2015

YOU TOO WORWOR! ALGERIA MAN DON TAKE HIM WIFE GO COURT BICOS SHE NOR FINE AGAIN A DAY AFTA DIA MARRIAGE

Bifor and afta make-up of woman
If u nor know di power of woman make-up,naim u go dey unda-rate make up.
Can u imagine for Algeria,one man don vex carry him wife go court sake of say di wife use make-up disivam bifor dem marry.
Afta dem marry,naim di wife bigin show di man her real face.
Di man sue him wife for N5milion for di ojoro and di pains wey di woman make him heart pass tru.
Di man even say,he bin tink say di woman na tiff wen he siam witout make up.
Siriosli,we fit feel say di man dey carry yarn but na who wear shoe dey know wia di shoe dey pinsham.
Di woman fit don turn pure ''iya-oja of worwor'' for di man eye wen she nor put on make-up.
I bin tink say mariage na for beta for worse,for good or bad,for worwor for fine but dis Algeria man don change am as he don swear say he must see di ending of dis mata.
Make una dey check back to know who go win di case bitwin di man and di woman for dis make-up kpalava.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...