MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 1 December 2015

I DEY SELL POPCORN N800 FOR SILVERBIRD BUT MY WORKERS SALARY HIGH PASS GOVMENT WORKERS OWN

Senator Ben Bruce,di owna of silverbird cinema,don reply one bobo for twita wey dey kriti-size am of selling ordinari popcorn for siverbird for N800 and yet naim dey sharp mouth say our gofment bad.
Di guy dey try let us know say,Ben Bruce no be beta pesin too as far as he dey sell popcorn N800 wey dem dey sell N100 for outside.
Ben Bruce wey dey represent Bayelsa east for senate kon reply di guy on top twita say,
Dat naim cup of tea bicos even tho he dey sell popcorn N800,him dey proud as he dey pay ova 1000 workas more dan N18,000 wey be di minimum wage for naija.


He say him dey proud wit imsef bicos our govnors dey cry say N18,000 too much to dey pay workas.
Just last week,Ben Bruce blast our govnors afta dem yarn say N18K a month too much for dem to dey pay workers.
Read wetin Ben Bruce tell di govnors for hia...http://ogakpatakpata.blogspot.nl/2015/11/devils-our-governors-too-wickedeven-dia.html?m=1

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...