MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 11 December 2015

KNOCK OUT PUNCH TO BABY DADDIES AS NAETO C DON YARN US ONE OGBONGE SiKRiT WHY HIM MARRY NICOLE

List of baby fadas among our celibritis dey inkriz evriday like price of fuel.
From Flavour to D' Prince,from Davido to Ice Prince,from Jesse Jagz to Wizkid,from Solid Star to Oritsefemi,from Dj Neptune to Kayswitch,from Terry G to May D,from Timaya to Seun Kuti,Olamide to even Obafemi Martins etc,etc,etc.
If i say make i dey write di names,una go need to buy me 40 leaves bicos 2B exercise book no go contain di names.
Bad as e bad,E get one bobo wey decide not to join dat club and he name na Naeto C.
Rappa Naeto C,marry Nicole for 2012 and dem don born one dota togeda as me and you dey talk.
He say di rizin why he use him church mind marry na bicos he nor dey for baby daddy and baby mummy mata.
Di ten ova ten singa,say,he cannot speak for anoda man but some pipo just like born outside marriage why some na mistake e take appun.
He say part of di rizin why he nor give all dis tolotolo babe belle na bicos he nor won train any pikin outside marriage.
Naeto C say na wen him marry,beta beta tins kon even inkriz more and more for him life.
He say Wen he marry naim he take bicom Glo ambasador for two years and some months ago,he don also bicom Yudala ambassador just like Iyanya.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...