MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 13 December 2015

GOOD HEART: FOTO OF AIR HOSTESS WEY DEY FEED PARALYSE PASSENGA DON SHOW FACE FOR INTANET


One of di duty of air hostess or pesin wey dey take care of pipo for inside aeroplane,na to dey veri veri frendli.
But some pipo fit be air hostess,yet dem fit nor do di kain good wey dis air hostess,Fan Xuesong,do for inside one aeroplane for China.
Dem bin dey travel from Zhengzhou-to-Haikou,naim 71-year old Niu,kon dey stroggle to feed imsef bicos of im condishon.
He dey paralyse and na even wheel-chair dem putam.




Niu,na dokita bifor and na him and him wife dey dey plane dey travel but bicos say u go sidon akordin to di seat wey dem giv u,him wife nor kon go fidam bicos dem seperate dem and she dey far.
As di air hostess see say di man dey find am hard to feed imsef,naim she take di wack from mam and start to feed di old man.
Wen one newspaper,di 'Zhengzhou Evening News' intaviu di air hostess,she say,na her duty to dey serve passengas.
She say as she just won start to fidam,naim di man,tink him life and start to dey cry.
E gud to do gud but go naija hospitas espeshali genera hospitas.
Na dia u go see di wickedness of most of our dokitas and nurse dem.
Nobodi go tell you bifor u go konfess wit yor mouth say,devil na saint for wia dis nurse and dokitas dey.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...