MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 23 December 2015

NICE ONE! GHANA PRESIDENT DON BAN DIA LEADERS FROM FLYING FIRST CLASS

President John Mahama of Ghana don ban public ofishas not to dey fly first class anytime dem won travel wit aeroplane so dat dem go cut down on anyhow spending.
Di law don start akordin to Ghana gofment yestaday so dat dem go stop to waste money wey dem fit take do beta tin.
Cominikayshon minista,Edward Omane Boamah,yarn say presidensi don first warn dia ministas and oda public ofishas last week say make dem avoid unnecessary abroad waka wit di tax payers money.
Ghana nor won hear say dia ekonomi kontiniu to dey drop naim make dem dey take some of dis actions.
Ova to you Buhari.
Yor frend don dey do wetin dem take dey klap for pesin.
Time don dey go.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...