MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 23 December 2015

I BE BADOO FOR BED - FADEKEMI MOMOH

Nollywood and yoruba film actress,Fadakemi Momoh,don yarn say,wen time don rish to play match for bedroom,she nor fit carry last lai lai.
She yarn all dis one wen tori pipo,NigeriaFilms,intaviuram about her pasona life.
She nor expet all dis queshons at all but she just maintain base on say pesin gasto ansa if dem ask u anytin.
Oya read di queshons and her ansas for di intaviu for bottom hia:


1.NigeriaFims: Wia you for do yor first fabbing?

Fadekemi: (laffing) were e won be if nor be bed?shuo!

2. How old u be dat year?

Fadekemi: i be 19 years

3.NigeriaFilms: You fit do abortion for any amount?

Fadekemi: For wetin na? I nor fit o!

4.NigeriaFilms: How many shidren u dey plan to born?


Fadekemi: i dey plan to born 3 pikin,i don alreadi born one,remain two.

5.NigeriaFilms: You gud for bed welwell?

Fadekemi: yes na! i be shampion o!Forget mathematics.Wen e come to bedmatics,i be fire.i ruff die and i dey craze for bed too.my man go give you scores

6.NigeriaFilms: Like say u nor dey act film,wich oda tin u for dey do?

Fadekemi: i for get big shop and show glass of nails bicos i sabi fix any type of nails

7.NigeriaFilms: u fit marry man wey nor too hol it?man wey dey manage?

Fadekemi:why not?sofa me and di man dey hapi for di mariage

8.NigeriaFilms: u sabi cook?wetin be yor best wack?

Fadekemi: Na curse?why i nor go sabi cook?i love to dey cook wella and na Efo Riro and Pounded yam be my best wackis


9.NigeriaFilms: Wen be di last time wey man kiss u?

Fadekemi: Lol!una kain queshon today na wa o.abeg make we skipam,na sikrit

10.NigeriaFilms: How u feel wen you first see yor piriod?

Fadekemi: I feel normal bicos I get 2 sinior sistas wey don get di experience bifor me.
So as i see di blood,i know say nor be injuri.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...