MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 12 December 2015

JULIET IBRAHIM DON FINALLY SHOW US HER OYIBO PEPPER BOYFRIEND AFTA SHE REJECT ALL AFRICAN BOBOS

Fine shenkez and Ghana home vidio babe,Juliet Ibrahim,don finally silence pipo wey dey tellam say make she show us her oyibo boyfrend wey she take dey boast.
She bin yarn some months ago say she nor send African guys again bicos of di way wey dem dey rizin about public figor.
Juliet Ibrahim don break up wit her forma Ghana hosband,Kwadwo Safo and dem born one boy pikin togeda.
She say di kain eye wey black pipo take dey look celibriti nor gel at all.
She kon yarn say na only white man she won to dey listin to now even tho say many African bobos dey disturb her life.
Juliet Ibrahim,join celibrate her white bobos birthday wen she write on top Instagram dey wisham hapi betday.

I dey sure say dis one na Arab white boy wit di foto wey I dey see so.
She post foto of di guy and write for bottom of di foto say,....
'Hapi betday to di only bobo for my life.i love you pass who dey craze... @_nabz.
I dey wish u God blessings,long life and prosperiti'.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...