MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 8 December 2015

LEARN HOW TO YARN AS FANS BLAST TIMAYA BICOS HE SAY,''THANK GOD SAY HIM NOR DEY DO 9 TO 5 JOB''

Timaya don land imsef for fans wahala for instagram afta he yarn about him kain work.
He dey smoke shisha wit him frends early monday morning and hand kon skratcham to write aboutam.
For twita,Timaya kon bigin tank God.
He yarn on top twita say,tank baba God say he nor dey do 9 to 5 job and na dis one naim make dem fit dey smoke shisha early monday morning.
Trust naija bois and babes.
Dem must yarn and reply u if dem feel say u don dey yarn puan.
Dem reply Timaya wella say,so pipo wey dey work from 9 to 5 nor be human being abi?
One even say,wot about pipo wey dey use dia 9 to 5 salaries soportam and buy him cds?
Check out more of wetin dem clear Timaya for bottom hia:


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...