MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 13 December 2015

NA LIE O! DAVIDO DON DENY SAY HE GIVE TANZANIA BABE BELLE

Naija star,Davido,don finalli reply tori pipo wey carry di news say he don give Tanzania model belle.
If Davido go blame anybodi make he blame di Tanzania babe,Agnes Masogange bicos di way wey di malawi take post di belle mata for Instagram page,u sef go pick Davido as di sharp shoota.
She post Davido HKN pendant for Instagram and kon say she dey miss Davido.
Afta di pendant post,she kon post her pregnancy positive test result.
You check and balance am.
Anyway Davido don come out from hiding say di babe don marry.
In shot,Davido just reply somebodi for twita wey yarn about di mata say, 'Na so una won spoil di poor girl marriage....,'
Misef don tire for all dis pipo jor!
Make I cross road go buy my akara.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...