MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 21 December 2015

NYANMA! ARGENTINA FANS WEY DEY VEX,DON SPIT FOR LIONEL MESSI BODI FOR JAPAN AIRPORT

Afta Barcelona and Lionel Messi difit River Plate of Argentina 3 kondo to win di world club compitishon for Japan on Sunday,nor be small tin appun for airport.
River Plate fans show dia pepper eye on Messi as dem spit for een bodi as dem dey connect tru di narita airport.
Di Argentina national team captain,Messi para no be small as he won fight dem but na Baka coach,Luis Enrique and team mate Mascherano,kon holam and coolam down.
E don tay wey Argentina fans dey vex for Messi as dem dey accuse am say na only wen e dey play for Barcelona naim he dey show say him na lion for field and if e rish to play for een kontri he go turn paper tiger.
Of recent,Messi say make dem go die if dem no like di way wey he dey play for him kontri.
Germany win Argentina for di final of di World Cup for Brazil last year and Chile also win dem for di Copa Amerika final.
All dis one also join for di fans annoyance.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...