MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 22 December 2015

ATUTUPOYOYO WOMAN GO FIT BORN DIS FLAVOUR PIKIN?

Some worwor women fit born fine pikin but make we yarn di truth,if man fine,woman fine,di chance say dem go born a veri veri biutifu and handsome pikin,dey dey veri high.
If u fine,u can't just carry born atutupoyoyo.
Flavour di baby oku singa wey like to dey whine waist for gehs,na fine boy and  forma miss Nigeria and di nomba 2 baby mama foram,Anna Banner,na fine malawi too.
She born one fine dota for Flavour last August.
Like play,like play,di pikin don dey mature dey go.
Ova-fine don envelope di pikin.
Chai!
She fresh finish.
Flavour you beta nor carry cutlass o bicos nobodi carry for u o.
U don enta one chance wit dis fine baby.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...