MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 14 December 2015

CHECK OUT WETIN ICE PRINCE YARN ABOUT FORMA KHAKI PRESIDO,YAKUBU GOWON


If diaris one man wey most Biafra pipo nor dey hapi wit,dat man na forma head of state,Yakubu Gowon.
Wen Biafra and Ojukwu dey fight gofment say dem no won dey inside Nigeria again,na Gowon naim nor let dem nor fit bend live Nigeria.

Gowon and di Nigeria army say,Naija must still stand gidigba as one.
Nor be small tin.
Anyway dat one na tori for anoda day.
Di tin right now be say,Chocolate City rappa,Ice Prince don pose and take pishor with Yakubu Gowon and write some kain tins wey make sense.
How many of una know say Gowon rule Naija wen he be 32 years?
If u nor know bifor,u don know today bicos na di guy be di youngest head of state for di hole of Africa dat time until pipo like Yahya Jammeh of Gambia 29 years, Joseph Kabila of Congo Kinshasa 29 years and 25 years old Valentine Strasser of Sierra Leone  come from no were kon snatch di record take.
Nor be dat one swit me sef.
Na wen Ice Prince say dem come from di same Plateau state and dem dey spik di same language 'Angas'.
Di Oleku singa say,he know say many pipo neva hia of dat language bifor and make Baba God uplift all dis language wey no big like Ibo,Hausa and Yoruba.
Oyibo dey call pipo wey come from dis kain small area,minority.

Nor soprise to see pipo dey print stickers like,"GOD UPLIFT THE MINORITY-Zamani 2015.
Bobos,u try for di punchline.
Na strong hook.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...