MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 4 December 2015

ANODA WONDAMENT! ARM ROBBER TO DIE BY HANGING FOR EKITI STATE BICOS HE THIEF N14,570

O boy ye!
See tori!
Dis tori be like film but no be film,na truth as big lawya,John Adeyeye,for one Ado Ekiti high court,don sentence one David Olugboyega to death by hanging bicos say di bobo tiff N14,570 from Kola Owolabi N8,000,Beatrice Olawumi N5,000 and Idowu Abiodun N1,570.
Wen dem dey judge di case,di prosikiutor Mr Alaba Adeyemi,yarn di court say, David comit di crime for March 20,2003 and na seven witness naim prove di case.
Dem say na gun and cutlass,take rob di three pipo.
David Olugboyega nor gree carry lawyer to defend him case as him gree say he dey guilty for evritin wey appun.
Di bobo confess say him don rob tire and na wen he enta prison naim he take join bad gang.
Na wa sha o.
Bicos of  N14,570 dem sentence pesin to death and pipo wey dey tiff billions for gofment dey waka free.
Na wa for wire road.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...