MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 20 December 2015

BURNA BOY DON LOOSE HIM BIGGEST FAN TO DEATH FOR AJAO ESTATE

My pipo,I swear,death na bastard!
Burna Boy don post on top Instagram about one Miss Anita_chekwas wey die on Saturday for Ajao estate,airport road,Lagos.
Burna Boy say him nor try at all for di babe life as he just find out say di babe na him biggest fan bifor she die.
Burna say if di geh put like ten foto for Instagram,out of di ten,at list for inside six,di geh must write about how much she value Burna Boy miuzik.
She even draw Burna Boy tattoo for her hand.
Di 'check and balance am' singa kon use di opotuniti pray for di geh soul to rest in peace and also beg all him fans say from now on,he go dey aprishiate and show dem love back.
Burna say,who know,dat kain aprishayshon for fit save Anita life or make her veri hapi.
Last Saturday for Ajao estate,I carry my family frends for inside car wen dem bigin talk about di gal death.
Dem say she just pass 18 years,she dey 300 level for one skul for east.
Dem know di babe papa and mama rish haus.
Di way wey di death take pain dem naim make I kon develop interest for dia diskorshon.
I hear wen dem dey talk for inside car say di geh die from sirios belle pain.
Dem carry am go churches,carry her go hospitals,dem stil nor fit kior di sickness bifor she die.
Na wen Burna Boy menshon Ajao estate as I dey read di tori wey him write on top Instagram,naim my mind fly go say na di same babe wey dose my family frends dey yarn about naim Burna Boy dey yarn about too.
Rest in Peace Anita.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...