MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 15 December 2015

I NOR DEY SURPRISE SAY EDDIE MURPHY DAUGHTAS NOR WEAR CLOTHES

Nowadays u nor need to be star for pipo to recognise you.
Na make yor papa or mama,yor broda or sista,yor hosband or wife,even yor frend or enemy just be star,naim be say u don turn star be dat too.


Tori pikin,Linda Ikeji sista,Laura,don turn star bicos of Linda.
Omotola hosband na star,Genevieve dota na star,Davido dota na star,AY broda,Lanre na star,Kanye West and Kim Kardashian dota na star,Burna Boy mama na star.
Make i stop hia bicos di list long pass 3rd Mainland bridge.
If nor be one tin one tin,wetin konsign me wit Eddie Murphy dotas nakedness.

Now,bicos say dia papa na big name,Bria and Shayne kon kukuma get di liva to dey naked diasef.
Maybe dem be models.
Na nakedness dem take start dia mata.
Who dia nakedness hep?
No wahala,make dem carry on.
Baba God dey record evribodi karata in 4D.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...