MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 3 December 2015

END OF Di ROAD: 2SHOTZ WIFE DON RUN LIVAM AS BEVERLY OSU GO DON DEY LAFF HER BY NOW

If yor career don dey die and you won kon use yor hand to kilam kpatakpata,make u just beat yor wife so dat tori pipo go hep u spredam.
Nor be joke,yor bizness go dry kpatakpata afta some few monts.
Wetin kon dey appun nowadays wey some celibriti wifes jost dey confess say dia hosbands don turn dem to punching bags for haus?
Emeka Ike wife pack comot for haus bicos of beating from her hosband.
Zakki adze wife fly live dia haus for Obanikoro bicos of dis beating mata.
Naija rappa,William Orioha,aka 2shotz "Umunnamu",naim be di latest bobo wey him wife,Precious Jones don sack as she accuse 2shotz of using her to dey do kick boxing for haus.
She yarn her close frend for whatsapp all wetin 2shotz dey do am for haus and di tin kon leak enta tori pipo hand.
Trust tori pipo,old mama don hiaram for village as we dey talk like dis.
She say e get one day for inside car wey 2shotz dey call her ashawo just bicos of her dressing.
She kon tell her hosband say he no soppose to dey call her ashawo as oda ways dey wey he fit take koret her.


She say bifor she say,Jesus christ is Lord!,naim 2shotz land her hot eba slap.
Dat kain slap wey dey make pesin dey see stars.
Precious say even di slap eskape go land for dia dota face too.
Akordin to how dem yarnam,karma na craze bicos if u do bad,God fit make evritin turn back come hurt u.
For 2013,forma big broda africa memba and model,Beverly Osu confess say,wen she dey frend 2shotz bifor,di bobo dey 'box her' wit hot hot blow.she say di beating wey she dey get from 2shotz dat time nor be hia.
Precious Jones kon blast her welwell for twita say,na crase yarns Beverly dey yarn as her hosband na angel.
She even say di truth go come out one day and now di truth don really come out.you see?
See wetin she tell Beverly for bottom hia:


2shotz and Beverly


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...