MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 9 December 2015

NA SMALL TIN REMAIN,POLICE FOR ITALY NEARLY ASK AKI AND PAWPAW WHY DEM NO WEAR DIA PAMPERS?

Notin pesin nor go hia for dis life.
To be dwarf don bicom problem for dis world?
E get one sikrit wey strong dwarfs and nollywood big names,Aki and Pawpaw dey hide for sometime now but dem just manage tell some of dia frends last week.
One frend kon tell tori pipo,now tori pipo don blow am and now di sikrit nor be sikrit again.
Di mata be like joke but na ebarassment to dem as e pain Aki and Pawpaw well.


Italo police for obodo oyibo,fall Aki and Pawpaw hand wen dem go dia togeda wit Julius Agwu go do show.
As di show promota carry dem for motto from airport dey go dia hotel,naim kporkpor(police),stop dem.
Kporkpor nearli arrest di show promota as dem kon dey para for di promota say why he nor put dem for baby carrier as dem be small pikins?
Na wen Aki and Pawpaw kon vex come down from di motor and show dem dia passport say dem nor be smallie,naim di police pipo kon take free dem.
Till today dem say dat drama stil dey pain dem enta dia bone as even Julius Agwu stil dey use di mata dey crack joke for some kain show.
Dem say wen Agwu dey yarnam for stage,pipo dey feel say na joke but nor be joke.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...