MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 17 December 2015

YAWA DEY: PIPO WEY THIEF NIGERIA MONEY,DON RETURN N8 BILLION NAIRA AKORDIN TO DINO MELAYE

Senator Dino Melaye,don yarn say,di politishans wey don tiff Naija dry,don return N8 billion to di kontri account.
I nor know weda he dey among dem sha,bicos I know say him don tay for politiks and of resent,tori pipo,Sahara Reporters,say,dem don diskova say Dino Melaye get dollar account wia he dey hide money put.
Dino yarn and revil dis sikrit of di 8billion naira to channels tv,wen he sidon do,one small join bodi intaviu wit dem.
He even yarn say,he know say,dem go stil return more money veri soon.
Ehen! make I even ask sef ..bicos e don tay wey dis queshon dey my mind.
Some of di money wey Abacha tiff wey dem later rekova,wetin dem use am do?
Abegi! make I go yawn for backyard jor!

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...